Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Choose Crypto Today And Choose Wealth.
by
Cityhunter34
on 20/11/2024, 17:59:49 UTC
In a country filled with unemployment and bad governance,crypto stood to create wealth and job opportunities for the youths not minding your status.You don't have to be great to start your crypto journey ,you have to start to be great. The worst thing you will do to  your self is not trying to learn.
The pain you will feel today  putting effort to achieving crypto knowledge that will create wealth is the strength of your tomorrow.

While doing this, also remember that the government can wake up any moment and ban crypto completely in the country so unless you get plans to relocate out of the country, crypto for Nigeria no be wetin you go out mind completely and ignore other hustle.

Make crypto just be one of your hustle as you put body for other things too. Definitely one go pay you out of the different hustle wey you dey involve yourself. There are opportunities out on the internet, browse with the right intention and you'll find things that can create you wealth. Crypto should be for investing while you get wetin go they pay you.

Crypto dey too volatile to dey depend on only am unless you wan add am trading so you fit they benefit from the volatility of the market but no go do wetin you no know unless you go lose wetin no good.
Nothing but the truth, normally we supposed no say our government no dey like hear anything about crypto for this our country, so e no go dey good for us to put all our mind for where cryptocurrency dey. because though just like as you talk we fit just wake up for one morning like this hear say government don ban crypto, wey be say you don already put all mind say na crypto be all our source of income. However, I think dey very necessary for us to get another place wey we go dey hustle small so that Incase of any emergency make we no say we get another hustle aside from cryptocurrency.