Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bitcoin hit 97k
by
Mpamaegbu
on 23/11/2024, 02:10:26 UTC
D way I see Bitcoin, e fit zoom pass $150k before Jan 20th next year self.
As e be now na only Trump fit make us see BTC for that price by that time next year..bet eh e get any price mark way be say BTC fit reach wey the price nor go increase again?
My broda, dis thing dey beyond Trump as e dey be but Trump na catalyst to how d price enta craze mood. Make we just sey, Trump na d Ugwali brand of marijuana wey BTC smoke to dey do dis volatility wey e dey do now. But even without Trump, BTC for still pass $100k.

~snipped~
so for sure we can't sa never but for now Bitcoin have been struggling to reach the 100k benchmark and that have become a tough benchmark to achieve for Bitcoin.
I nor know d data wey you dey look at but from wetin me dey see, Bitcoin nor dey struggle to reach $100k. D dude even did $99,600+ yesterday, breaking its two days ago ATH of $99,400+. Wetin I see wey dey happen be sey na small manipulation wit whales to get out those wey dey expect retracement at dat psychological level of $100k. So many hodlers dey target dumping around $100k and den buy back from d action of their dump. Bitcoin fit disappoint dem and zoom pass dat $100k before retracing later.

Quote
Bitcoin may likely be around 150k by this time in 2025 but not until then, we are going to be seeing some significant market movement that could take everybody by surprise and longer time is going to be taken before we see such miracles happening in the Bitcoin market.
Well, while dis isn't a financial advice; make I just drop something for you. By dis time 2025 (dat's November 2025, right?), na red we go dey observe for dis space. Go check historical data and you go realize how shortlived bull season dey be. I nor go talk pass like dis.