Did we also learnt something about this story? I think it's karma that struck this my guy. Who knows how many vulnerables he has dubious while trying to help them with their crypto wallets.
Yes, na greed make ur friend fall mugu give those thieves. Na persin wey thief dey im eye dem dey quick catch for something like dat. Na old trick wey I noticed in 2018 or so. D first time wey I observed it for wan telegram group wey I dey then, I rush make I DM d dude wey make dat post to quickly delete am, believing sey na newbie wey mistakenly exposed im passphrase. Na so I begin read people comments calling d dude wey expose im seedphrase a scammer. I was shocked as per how persin wey dey seek help from community com become thief again. E confused me, nor be small. Na until people come begin explain how the scam take dey go I com understand. Anybodi wey still fall for dat scam now, nor soji at all.