Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerians preferred to learn things the harder way.
by
Ndabagi01
on 31/12/2024, 19:12:38 UTC
Our young people are uninformed of current knowledge that is constantly circulated; they are just concerned about obtaining quick money, which has pushed them to accumulate it through unscrupulous means. They only show concern for projects that are successful; they make no contributions to anything that is growing, preferring to serve as hosts and keep all for themselves. The youths are also done, how can you explain this, a full-grown man continues to depend entirely on gambling to feed, it's ludicrous because this is the modern period and everything is progressing to the next level.

Wetin you dey yarn now about naija youth no be so e be entirely and if you wan dey talk about things like this, make you no dey generalize am because we no dey the same and most of the youth today for naija na hustlers wey they look for legit money and them dey really work hard to achieve am.

Example wey I go give you na this forum sef, which other country for Africa you see say dey here wey dominate here if no be only our naija people only. Things like this dey to dey remember us to be honest and look for means for survival the legit way but make we still dey appreciate people wey dey really hustle well to make am and them no do anything illegal to take achieve am.

The number of people wey dey gamble plenty but e no mean say as them plenty like that, plenty of them na him dey use that means as their only means to take survive, make you sef reason am say no be so e be and you no suppose generalize am. Some dey do am for fun and you no go talk say them they use am for survival or take escape poverty.