Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Work for person this year, trade forex or gambling?
by
Mpamaegbu
on 08/01/2025, 07:44:49 UTC
⭐ Merited by sokani (1)
Another one na forex trading and gambling I just put them together because them dey like brothers...
Honestly, I dey always laugh weneva I see people compare forex trading with gambling. Ok, if una dey compare forex trading with gambling why una no dey also compare crypto trading with gambling? Abi both of dem nor be trading? Anyway, wetin I realize be sey na d mentality of "wet rich quick" wey people carry enta forex trading and dem nor com meet am dey make dem wrongly conclude sey na gambling because na d same mentality dey gambling.

Forex trading na business of buying and selling just like the local market sellers and buyers. D difference wit forex trading be sey na online dem dey do am. So, in gambling wetin we dey buy and wetin we dey sell? If d local merchants nor dey expect to get rich quick overnight, wetin make you wey dey trade forex think sey e go dey possible for you? Money dey forex trading and e nor be gambling but you've to know your Money Management techniques very well to succeed. Don't aim for 10% daily profit as a starter. For instance, don't aim for $50 daily on a $500 account. You go blow ur account. Aim for $2-$5 daily and from there build confidence and master ur strategy. Make sure to use SL (Stop Lose). It's very important.

As for working for someone while you're on dis forum, it's not a good idea. Except you be newbie wey neva spend up to a year here and u neva get campaign. Once you enta campaign begin plan to set ursef up. Build ur resources and find oda online jobs dey do. Learn trading (cryptos, FX, Stocks, Index, any trading wey go suit ur lifestyle). Nothing sweet reach online biz. D comfort and freedom nor be here.