Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Work for person this year, trade forex or gambling?
by
Richbased
on 09/01/2025, 22:28:12 UTC

So this year how person wey dey do these things want take cope and how much profit and loss you as an individual Dom calculate from your own side and how u dey take control or cope with the addiction.

Make we hear from you person fit dey here to learn from our own contribution.

Wetin me i go just contribute be say everybody get one thing wey dey work and favor dem so as person dey condemn sometin, na so anoda pesin dey appreciate the tin and na so life be. To work for person no bad but wen u continue wit the mentality of working for people without thinking on how to establish your own sef, na im be where e bad. For a gambler and a forex trader, since the two dey work like brothers i go say dem no too bad as most people dey see am but e dey depend on the approach wey you take follow your gambling life or your forex trading because the one tin wey dey affect people wey dey into these two categories na to dey greedy. If you don trade come get some profits why not leave the market till you get a good signal wey go make you to enter another trade but some people go still dey trade even wen dem no see better signal. Gambling own be say e no dey easy o especially for pesin wey don already fall into addiction but e get how pesin go manage yin sef wey be say all dos tins no go affect am or worry am not to give attention to other tins wey go help his life. As a gambler, if you get luck win small money na just to stop to gamble yet take the money do better tin so that even when you play and lose you go get wetin you go point hand say naim be wetin you achieve from gambling.

Person wey dey do the three things wey you listed fit cope very well as far as they know their limit and how to handle all of them without going above their capacity.