Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Work for person this year, trade forex or gambling?
by
SmartCharpa
on 10/01/2025, 10:08:01 UTC
Three of these things na something wey I sight say people wan dey try remove body for, to work for person to trade forex and to dey play gamble weda for casino or online. Me myself I Dom reason am for our country as e be like this now I no sure say to work for person fit favour person again especially when e come be say u dey alone or u dey feed family and salary no come balance this one na one of the things wey people really complain of last year.

Another one na forex trading and gambling I just put them together because them dey like brothers, one of my friend call me after the new year, bring him phone and book dey calculate all the money wey him spend for online betting account and forex trading Omo the money too much but that bobo go always tell you say money no gum am but everyday him dey trade forex still dey play gamble. These three things wey I mention sometimes fit control mental health those wey dey trade forex go know wetin I mean that one na when u allow am be addiction you fit dey calculate forex ur brain dey hot sef the same thing with gambling,

So this year how person wey dey do these things want take cope and how much profit and loss you as an individual Dom calculate from your own side and how u dey take control or cope with the addiction.

Make we hear from you person fit dey here to learn from our own contribution.

Op just say about yourself and other people that you know, otherwise, many people are out there who are praying to get a job even though na to dey work under someone. Even as you see say cost of living wan finish us for this country, e no mean say people no dey seek for a job under someone, some people no dey mind, dey just wan dey feel like they are earning some little amount of money wey go put food for their table.

Regarding the forex trading and gambling, na waiting dey kill most of our youths be that, a lot of them believe that the only they could make it is either gambling or forex trading, if some people calculate the money wey dem waste for gambling and trading last year, you go pitty dem because if they use the money do other important thing dem for don archive something for their life. Gambling is meant for fun but for this country we put am for head as means of income, this is 2025 e better make we use our life very well to achieve good things for this new year.