Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria needs Bitcoin national reserves
by
Tonimez
on 13/01/2025, 23:23:41 UTC
With Bitcoin on the rise and many European countries having Bitcoin national reserves
Which European countries you dey talk about, hope you understand say because country dey hodl bitcoins wey dey seize from criminals, e no mean say dem dey hodl bitcoin as a strategic reserve. For example, the United States don dey hodl bitcoins wey dem seize from people and institutions, but na now wey dem dey talk about a bitcoin reserve because of the new president.

If i go dey honest, bitcoin reserve no be Naija problem right now, we get different things wey dey worry our country right now, and if we solve some of that, then we can talk of things like this.
Na the point be this. I just dey try remember countries wey he dey talk say they don get bitcoin reserves already. Even powerful nations na now wey they still dey reason open a bitcoin reserve. Naija no be that kind country wey go invest in bitcoin reserves.

The whole world still dey wait make US take the lead. Even Russia just dey propose am first.

Naija economy never strong to invest on wetin they no sure say the value no go crash when they need to use the fund for other things.