Another one na forex trading and gambling I just put them together because them dey like brothers, one of my friend call me after the new year, bring him phone and book dey calculate all the money wey him spend for online betting account and forex trading Omo the money too much but that bobo go always tell you say money no gum am but everyday him dey trade forex still dey play gamble. These three things wey I mention sometimes fit control mental health those wey dey trade forex go know wetin I mean that one na when u allow am be addiction you fit dey calculate forex ur brain dey hot sef the same thing with gambling,
So this year how person wey dey do these things want take cope and how much profit and loss you as an individual Dom calculate from your own side and how u dey take control or cope with the addiction.
Make we hear from you person fit dey here to learn from our own contribution.
E been get this guy wey I dy follow for this social media wey dem dy call X, them dy call the guy Mr. Banks. The guy they do crypto and him dy gamble but him primary means of making money na gambling and when he make much, him go put am for crypto dy buy more Bitcoin and he was doing it since when Bitcoin they small price and now the guy na millionaire in dollars and he still making money from gambling anytime wey him bet, some people are really good in it.
I don try follow up some of them for this gambling business but make I no lie you, the thing really hard me make I no tell you. I been dy lose money wey d thing come discourage me that I have to stick to my regular games wey I dy bet on Saturday and any days wey dem get other important matche. This gambling of a thing to make wealth no be for everybody, I still dy put body for crypto as I still they mount everyone but gambling na time to time.