Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Campaign For BTT community awards
by
DPHOR
on 16/01/2025, 11:16:13 UTC
NB- This voting is to last for 60 days but from the time wey the thread was created till now, about 12 days don already pass which means that we have only about 48 days left for this voting.

And again, the voting na for people wey get 50 earned merit and above so make una take note of that.

Any user has the right to conduct campaigning in a separate thread, specially created for this purpose.

We know that many users do not go beyond their local sections, so we would like to know whose names represent this or that community. Well, let's see whose local community is the most united?
This last part of your post made me to understand say e good make person read before them go join wetin them no sabi. I been come across this post for meta but I no gree join because I think say member rank no qualify to join or maybe na only from full member fit Join the voting, as you bring am come here e come clear for ma eye say even though I been member at least I don enough merits wey go qualify me to go cast my vote.

Keep that aside, I rili like  as bring up this mata for we community like this because plenty things dey happen no be every bodi for we obodo know say this kind thing dey go on, but as you ginger am come hia plenty pesin go know say this kind thing dey go round for the community and e go help wella to cankpe wit person we want make in gym the award come, anyhow e be I rili thank you for the information you carri come we doormot.