Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: crypto vs content creation, which is more profitable?
by
Mpamaegbu
on 17/01/2025, 16:20:31 UTC
Since most youths have seen that social media skit makers are cashing out big and living expensive lifestyles...
Abeg, make anybody nor allow anything on social media deceive dem at all at all. Most of those ones displaying such ostentatious lifestyle nor really be like dat for real life oh. Na just media hype. Again, shebi we dey follow dat unfolding story of Timileyin Ajayi, the so called gospel musician, wey kpai him girlfriend, cut off her head. Of course, e nor go pass ritual wey him wan use am for b4 luck ran out on him. If he had succeeded, na so many people go dey hail am, dey tap 4rm his grace like Tapswapers, dey wish sey na dem dey dat successful. Not knowing sey na criminal enterprise dat dude dey into. Na so most things online be.

Quote
Which is more profitable? Content creators or crypto traders/investors.
For me oh, nothing comes close to cryptos and everything online trading. Wetin even be wealth wen you nor get rest of mind and dat peace wey gum am for body. I fit nor open my mouth talk or leave my room but money go enter. I nor need to adjust myself to anybody's thinking pattern, whether people go like dis thing wey I wan do or talk, whether my fans go dey disappointed or not wit my outburst. As a trader, my fans na good network and my device. Na only their disapproval fit make me panic.