I greet una my country people. As we all know this our country condition don dey pass be careful, things done dey get out of hand. My question Na how Bitcoin fit take in any way help in making Sure the less privilege fit afford to purchase or invest in Bitcoin through any ways, since we all know the hiking level now.
Bitcoin don dey contribute greatly to Nigerian Ooo. yes, e don dey help us well well. If you observe am, you go see say plenty Nigerian youth dey unemployed, unemployment reach to dey alarming. But since dem discover say Bitcoin dey exist, dem don forget say government job even dey again. Dem start to dey invest and trade with Bitcoin, dey work for cryptocurrency world to get financial stability for dem selves. Bitcoin don dey do wonders for Nigerian citizens, but up till now, some pipo no know say e dey exist. Dem no know say Bitcoin be opportunity to make money, to get financial freedom. Dem no know say e fit help dem take care of demselves and dem families.
We suppose mak our pipo know abt Bitcoin, to educate our pipo about am. We suppose show dem say Bitcoin no be scam, say e be legitimate way to make money. e go gud mak we encourage dem to learn more abt Bitcoin, to start investing and trading with am. If we do am, e go help reduce unemployment for our country, e go help our youth to become financially stable. If pipo get somtin lik bitcoin 4 hand, I think say even the illegal activities go reduce 4 the country, becos som pipo dey Join am becos dey no get anytin wey dem go do to put food 4 table.