How many of us can remember when everyone was tapping on their phone continuously Just to make money, projects like notcoin, dogs and hamster Kombat made people think that getting paid by doing such tasks would happen consistently. As time went on a lot of other airdrops that started coming up were just a waste of people's time, energy and effort. Right now most of the ongoing projects that were once popular like Blum and the rest of them are losing value, a lot of people are no longer interested.
Most people don’t tap tire, and at the end, Wetin dem give them no really worth am, and some of those coins self, dem no list them on exchange, so e just be like say there effort don wastes. Make I use Hamster kombat as example, we all saw how people Dey tap their screen that time just because they wan make money, some people tap screen for like 6 months hoping they going to get millions of naira, their expectation don too high, and at the end, most of them get less than $20, and some people na $2, $3, $4 na him dem Dey see, so you self reason am, how people no go discourage.
Me self participated in some telegram airdrop, Dey get some wey I get some reasonable amount of money, because Wetin I get for catizen no really bad, but most of those airdrops, make I no lie you, na dust dem give people, since na money everybody Dey look for wey Dey make dem tap screen, and they no come Dey get d money, na y plenty people lose interest be that.
Me self get like two wey I Dey do wey Dey don Dey talk about listing since, but nothing sup up till now, and I no Dey sure say dem go list those coins, and even if they later list them, me self don know already say na dust people go get from the coin.