Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 2 users
Re: Getting a good education on crypto currency needed before investing in it
by
Pablo-wood
on 21/01/2025, 17:55:41 UTC
⭐ Merited by Y3shot (3) ,CryptopreneurBrainboss (2)
That’s just the facts most of the people are lack of enough knowledge, and that’s why when ever they come to invest in any coin their definitely fall down; especially when is Bitcoins investment that deserves much knowledge about, but they will know educated their self first before made decisions about Bitcoin investments.

Bitcoin investment doesn't need much knowledge to succeed in it, make people no go lie for you. Wetin dey here na to buy, hodl and sell when you dey satisfied with the profits them wey you done get based on your plans. Bitcoin investing no dey as complicated as we dey wan make ma. Suffer say you dey updated on the latest scams them and you no dey participate for anything apart from just hodling your Bitcoin, you no get shaking. Update nii dey finish so you need dey stay updated as you dey hodl na why I say you, you no need learn every single thing before you buy. As you dey wait self you do dey miss better price them wey you for enter the market to place yourself for better position to fit make better money from hodling. Get the required education that you need so you don't be an ignorant investor (that's all that matters).
E just be like any other business you fit think of. Ok make we use palm oil as example. When person buy palm oil for large quantity store am. Maybe him dey predict say by November palm oil go scares or celebrations go start to plenty during that period so him dey plan to sell the palm oil during that period and things come go as him take predict am him go make good profit. But e no mean say the prediction go dey accurate all the time things fit come change due to some kind circumstance. Na the same thing with Bitcoin. We go buy Bitcoin and just like we study season for the palm oil we go follow study market trend for Bitcoin and some other fundamental factors before we decide when to buy, if na short term goal we go specify our price target or if na long term goal we go specify how long we wan hold our coin. Him no need to know everything to start. E even better as you the learn while you dey invest, e go give enough experience and risk management techniques.