There's need to educate people about crypto currency before they do any investment on it.
What is your view on this topic let share our thoughts so we can learn new information about crypto currencies here.
D koko be sey everybodi like d smell of money. Nobody go wait once dem feel sey dem don see opportunities to make dat money. If you nor help dem do d investment dem fit begin see am like sey you nor wan help dem make money. For me, wetin I dey look at to onboard any new persin na to make sure sey I teach dem wallet security before allowing dem to invest. I nor dey like buy and keep any cryptos for anyone. I go fit help dem buy am but na dem go hold d app and seedphrase by demselves. Then I go tell dem to read up on it if dem dey interested. Na so I take learn to. For my own case, I nor even get any mentor to teach me like a nursery school pupil. Na cut and join I take bring myself up.