I no fit talk all the differences here but these ones na the key ones I know say others get too to add, but las las abeg trading and gambling no be the same thing,
True true trading and gambling no be the same thing, na two different things wey fit wound you wetin no good, but one major thing wey I pick out from your write up is that luck fit shine on you in gambling, but in trading, if you no know anything about am, you don enter one chance because luck no dy work for trading, you earn base on wetin you know, and how good you can control your emotions, but as for me, I see two of them as a dangerous game, especially trading because him dy even more brutal than gambling.
The emotional trauma wey come with trading is second to none, that time wey you no dy trade, you go feel like say na that Times you for make enough money, but once you enter wrongly, ur eye go clear, because the market go humble you sharp sharp.