Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: What better ways can Bitcoin contribute to the economic situation in the country
by
Sonia_123
on 27/01/2025, 21:29:54 UTC
I greet una my country people. As we all know this our country condition don dey pass be careful, things done dey get out of hand. My question Na how Bitcoin fit take in any way help in making Sure the less privilege fit afford to purchase or invest in Bitcoin through any ways, since we all know the hiking level now.
Bitcoin don help us well well, imagine sey you learn work finish, dem come give you work inside,no be better thing den do for you, and dem still show you ways to make money and manage your life on top.
Bitcoin don do everything for you o o o, wetin remain for you na how you go achieve your success by yourself because when you don learn your Bitcoin,come get 100 merit, the next thing na for you to apply for campaign or signature jobs wey you go fit take dey live your life dey go.
For investment wey you talk, DCA strategy dey wey dey very easy to use because if na any amount you wan take start, no matter how small you get, you go fit dey buy BTC small small dey keep,so that you sef go follow for people wey dey invest into Bitcoin, DCA no dey worry person at all because na the quantity wey your money reach you go buy at anytime wey you wan buy, e no dey necessary sey na one particular amount you must buy, na as your power carry na him you go buy and save, because the price go dey go up, and you fit take your money back anytime you want , or even say you no wan invest again dem no dey force person to invest na as you like na so e dey.