I greet una my country people. As we all know this our country condition don dey pass be careful, things done dey get out of hand. My question Na how Bitcoin fit take in any way help in making Sure the less privilege fit afford to purchase or invest in Bitcoin through any ways, since we all know the hiking level now.
No matter where the level of Bitcoin hyke reach, the less privilege go still afford am but Dem go just buy the level wey Dem fit buy. Person must not buy one full Bitcoin but you fit buy am in fraction meaning say you go buy as your pocket fit buy. And I want you to know say Bitcoin no be poverty alleviation program wey be say if you just buy am say you don becom rich man. For you to get better thing for Bitcoin, You gats needd to buy Bitcoin strady maybe weekly oronthly and Hodl am for long time maybe like 5-10years and abov before you go think of better thing inside am.