Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Telegram airdrops are losing their value
by
Obari
on 28/01/2025, 22:47:53 UTC
~snip~

E no get anybody wey dey Nigeria or the crypto space wey go say him no hear about this tap to earn madness.

I no sure say my grandmother been hear about the tapping madness😂

Omo at some point, I come Dey feel left out because the pressure was massive and the kind figure these men been Dey call been Dey really heart breaking as na billions and millions these men been Dey call and most times, if you Dey in the midst of tappers, you go understand the true definition of pressure😂

On a more serious note, I wasn’t moved because I just knew, these tapping matter go definitely come and go and since I no been get the strength to tap, I come Dey pray make people wey tap get better thing atleast make joy Dey the squad.(win for one suppose be win for all.