Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: TRADING IS NOT GAMBLING
by
Obari
on 29/01/2025, 00:43:34 UTC
Even though trading and gambling resemble for face that resemblance no pass for face there, u go make very serious mistake to think say trading and gambling na the same thing, and if you enter trading with that gambling mindset wahala go dey. so weting be the difference between the two

Gambling na just game of chance like say you need dey every lucky to win but trading is more about your skills. The skills wey you dey learn so for trading go help you win tomorrow but you no fit talk the same for gambling.
I get your point Senior but I think say, some other persons Dey also develop some skills due to their frequency with gambling.
I no Dey try to relate gambling with trading but one thing I know be say, regardless of how much skill person get for trading, losses go still occur because all the charts traders Dey follow Dey o my help them to speculate which means say, then no fit Dey certain of wetin fit happen next because the market na very unpredictable one and hence I just wan talk say, trading and gambling get some major similarities na why people no Dey waste time exotically newbies to tag trading with gambling.