Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: TRADING IS NOT GAMBLING
by
K_vin
on 29/01/2025, 06:41:38 UTC
Even though trading and gambling resemble for face that resemblance no pass for face there, u go make very serious mistake to think say trading and gambling na the same thing, and if you enter trading with that gambling mindset wahala go dey. so weting be the difference between the two

Trading and gambling has being a topic of discussion for a long time because of the similarities between them, trading to some people na gambling 2.0 (Dem go say na gambling wey go university). You no go blame them because them no get the knowledge to know the difference and some of them no sabi wetin trading be, na why them dey always talk this thing. Trading and gambling na two totally different things and although you done try for this points wey you give but I want to add that,

Gambling na just game of chance like say you need dey every lucky to win but trading is more about your skills. The skills wey you dey learn so for trading go help you win tomorrow but you no fit talk the same for gambling.
Thanks you boss, na just the truth be that, I wish say I fit get avenue to dey sensitive people say the two no be the same so that them no go dey carry gambling mindset dey enter trading