Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Is education really important anymore for the Nigerians?
by
Different patterns
on 30/01/2025, 19:54:10 UTC
No let person deceive you do wetin your mind no tell you because as Nigeria don dey go now no be time to debate school issues as students dey complain. One thing I believe myself be say anyhow people complain about something your case fit be different, na to just gather self courage already no be all fingers dey the same. People fit dey complain now say graduate no get work maybe when you graduate finish you go see work. This issue na common issue as matured men go always say school no get value, the reason why I mentioned aged men because I don hear am wella from their speech, for example e get one time I enter keke and youth corpers full road just imagine wetin the papa wey sit close to me talk, he say after all this struggle no work for them and e better make person carry time learn handwork than to go school. I reason this statement and I relate am with the Nigeria top fashion designer Veekee James, this lady na inspiration to people wey no get money to go school but rather make them purse their dream, school fit work for Mr A but Mr B own fit dey different just depend how you take follow your dreams.
I read your comment and I understand am well, wat you just said nah de truth be that, imagine a friend of mine got admission to higher institution, pesin dey one corner dey vomit rubbish say waiting you want go do for school? Him say him don graduate from school since 2020 and him never see work up till now, shey going to school nah wasting of time make he go learn hand work, when he supposed to encourage am, he dey discouraged him no to go school, when everyone destiny dey different,
       Nah problems of some people b dat they can never encourage  children to go school, and school now is very important aspect of human life as technology is developing everyday.