Even though trading and gambling resemble for face that resemblance no pass for face there, u go make very serious mistake to think say trading and gambling na the same thing, and if you enter trading with that gambling mindset wahala go dey.
You sabi dis wan, I nor go lie give you at all. I don read tire for here wit some of owa people wey dey even argue sey trading na gambling. Na just wan thing e go mean wen people begin talk dat way sey both na d same and dat thing na sey dem dey lose weneva dem trade. Dem buy, dem lose. Immediately, dem enta sell dem still lose. Any angle wey dem follow, dem go still lose. Dat wan go begin dey confusing to dem and na im make dem dey compare am wit gambling. E nor be so. Wetin dem lack na skill set and patience wey trading dey news. Wit trading e get wetin dem dey buy and sell but for gambling e nor get anything wey dem dey buy and sell. Na just imagination or picture of hitting jackpot dey drive people to participate for gambling. E nor be like dat for trading.