Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: When is the best time to sell your investment.
by
Cityhunter34
on 05/02/2025, 04:35:21 UTC
Good morning my senior men for the furum. I greet una.

Considering the way bitcoin prize they fluctuate today em dey down, tomorrow em don high, many people including me I dey little bit lost I no fit know when to sell again.

you fit sell today at a current value of $100,279.70 and tomorrow the price skyrocket or you fit say you Wan leave am make the price high small before you know the price don fall.

So na watin need quick attention, make we talk am so one fit know when best to sell our investment. Thank you
See make I tell you Bitcoin investment no be something to get rich quick, e dey required proper knowledge and patience. That's why Dem dey always talk am say make people dey plan dere self very well before dey invest in Bitcoin, because e no be were person go just wake up one morning and start making money from it. E dey always take a long period of time, and as a new investor wey really want invest in Bitcoin before you go fit hold your Bitcoin well na when you stop to dey monitor the market price, because if you continue to dey check am e go make sell your Bitcoin when you are not supposed to sell it.