An adage says that what you don't know is bigger than you, if you go into a business without proper research, it is likely that you can make avoidable mistakes. Many people think that crypto trading is a get rich quick scheme because of what they hear on social media and from what people that don't have trading experiences tells them. When they lose all their money due to inexperience they will call cryptocurrency a scam. People that have not taken their time to learn about technical analysis of trading and be mentored by experienced traders are no different from gamblers who are depending on luck to make profits.
Most people wey go come online Dey go come Dey call crypto scam no really sabi wetin crypto even Dey about, most of dem Dey go invest in all this shit coins, and if dem lose money, they go come Dey blame bitcoin for the mistake wey dem make, and dem fit avoid am, but since na quick money dem Dey look for. I hear say him sister lose money for crypto, but na all dis meme coins na him she go put money, and she lose money, she come Dey complain.
If we wan invest in crypto, first thing wey we suppose know be say make we get proper knowledge about crypto first, we no suppose just jump into crypto investment, we suppose sabi plenty things before investment, because we might end up losing money even after investment. We suppose know coins wey we go put money, and d one’s wey we no suppose put money, we suppose sabi wallet wey we go use, and how we go take Dey secure our wallet.
Seun kuti no sabi Wetin crypto Dey about now, him just Dey talk base on Wetin happen to him sister wey him see, and him no even care to do research about where him sister get things wrong, him self just conclude say crypto na scam.