Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Focus more on accumulating Bitcoin rather than memecoins
by
Stable090
on 09/02/2025, 22:50:09 UTC
The story is different as Bitcoin is the hope and vision of many so my Nigerian people when going into crypto don't invest your hard earned money into any meme coin that you're not sure of growth in the future but invest into Bitcoin because Bitcoin is proven and trusted over the years
E Dey surprise me say na meme coin just full some people wallet, e come Dey surprise me how those people Dey get mind Dey hold meme coins like that. Something wey be say na hype e dey always get, if hype Dey, e go pump, and if d hype die, you go see say the coin go just dump, so how you go take leave that kin coin for wallet Dey look? Most people wey Dey put money for meme coins are just looking for quick money, but most of dem Dey allay lose money in d process.

The best investment na just bitcoin investment, if you put money for bitcoin, you self go get peace of mind, you no go Dey Check wallet frequently maybe money wey you leave for there don disappear. If you invest in bitcoin, the highest wey fit happen na him be say make d coin dump, and if you can hold, then d price go bounce back, but e no go possible say you lose all your money, as long as nobody hack your wallet.