I came to understand that many people don't really know how to explain bitcoin investment to someone else, they only tell them that bitcoin is a cryptocurrency,an investment that can give them higher return when they invest in it.
If I wan introduce bitcoin to people, firstly I go tell them say dem fit make profits for bitcoin if dem hold for some time, or if dem Dey trade bitcoin, but risk wey Dey make we Dey trade high pass make we just buy and hold. Most people Dey always talk positive things about bitcoin, just to encourage people to invest in bitcoin, but they will never tell me people Dey can lose if dem invest in bitcoin, so plenty people wey Dey invest in bitcoin just get d believe say if dem put money for bitcoin, Dey go make money, and Dey no go ever lose, so if dem later lose money, Dey go come Dey disappointed, some go Dey call bitcoin scam, and na because dem no get proper orientation before investing.
I understand your point cause as the level of inflation done too high, everybody they look for the way forward to get money survive since this current government no send anybody papa, anyways wetin people dey think about na something wey dey bring money sharp sharp that's why this period eh dey kind of easy to scam people cause no be only ignorance but desperation to make money done make several people to fall victim.
Wetim i dey try yarn na be say if you start by telling people wetin dem go benefit inside first i believe say the bitcoiner go atract more people to pick interest concerning am. Anyways if i wam teach new people about Bitcoin na to first tell them wetin dey go benefit inside before i begin they talk about the right coin to investment on wey be Bitcoin then teach them how to go about am.