How we dey naija, Okay let's do something unique today, tell us your current location, 3 square meal you plan to eat today, Give us one wisdom quote, tell us one thing bothering you and finally tell us what earns your money? You know our naija people help from each other, make we follow learn. Thank You
Wetin be the meaning of this thing here, you think say we come play here?
If you no get anything tangible to talk about, it's better you stay mute, no dy loiter our local board with meaningless post. Please be guided.
E be like If you catch this person, yo fit comot him teeth but sir please take it easy on us the new members because it’s not as easy as you might or be for you as we’re all trying to fit in and no one came here 100% knowledgeable of the ways for the forum, so instead of you to bullshit this poster, why not write in love to boost his morales and of a truth even me wey no be the poster, I felt bad because as a new member, i fit also collect at anytime even from my own brothers wey suppose make the local board a safe haven for new members and help guide dem but rather the reverse na the case as thrm in turn the make the local board a difficult place to accommodate we the new menbers.
I no Dey supposed say make people post rubbish for the local board, but just with the case of this op, I see am like person wey Dey really put in so much effort to contribute to the local board and forum at large but I think his been bruise with his first response.
Sometimes I Dey really reason the kind backlash I Dey get from a thread and e Dey fear me to create them.