Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Accumulating and holding is more profitable and less risky than trading.
by
Stable090
on 20/02/2025, 21:33:01 UTC
I always tell people that if you want to succeed and get better profit in bitcoin especially as a newbie then invest in BTC by accumulating and holding for a long period of time not trading
If you wan make money, and you wan get peace of mind, then e better to invest in bitcoin for some time, but even people wey Dey trade Dey make money also, no Dey surprise say if you calculate money wey you go make from trading for years wey you use hold bitcoin, and profit wey you go get fit be the same thing. The only thing wey Dey trading be say, d risk too Dey high, if you Dey trade, you fit lose everything wey you Dey use trade, if you no be professional yet, but people wey really understand wetin trading Dey about go tell you say money Dey trading.

Me I Dey always invest in bitcoin, and I Dey trade also, since my investment na for long term, my mind no Dey even go that side, but I Dey use money wey I Dey get from trading guide myself, and any day wey loss come, na too take am like that, but I no go lie you, money Dey trading also, na just d risk wey Dey.