Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: A friend scammed me of my PI
by
Stable090
on 21/02/2025, 20:07:54 UTC
Nigerians why can't we just be truthful to one another for once, writing this in pain. A scammer i consider as a friend scammed me of my 115 PI. His excuse was that he sent it to his own vendor to buy it but up till now the vendor has not sent the money and also the PI back. The main reason i sold was because i needed that money day before yesterday i couldn't wait again for the listing. Now i have nothing! What can i do to such a friend because am tired and we are not even in the same state?
Dis one weak me ooo, that person wey you Dey call your friend, no be ur friend ooo. That one na your enemy. Now wey you send your pi give am, him no send money give u, and him no return your pi give you, if to say you know say na Wetin go happen be dis, you for just get patience, hold your coin then sell am when Dey list am, you for even go find place borrow money self.

With Wetin don happen now, baba I no really sabi how you go get your money back ooo, make you just continue to Dey mount pressure on that your friend, if you get luck, then you go get your money back, but make sure say you avoid that your friend ooo, him no reall mean good for you.

You wey even talk say you need money, you no fit wait till dem list pi, then Wetin you wan use d money do na emergency, him suppose even pity you. I no Dey sure say d problem na from d vendor, because him self no go use vendor wey him never sell for before.