Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Our economy, a challenge to DCA plan.
by
Gozie51
on 25/02/2025, 10:04:58 UTC

Do you agree with me that the economy na challenge to the plan to try invest for bitcoin through DCA?

Yes I agree with you and totally so because na person wey chop go fit see wetin dem go save either for "bank" or through DCA on Bitcoin. If you don take care of your bills including health bills, you go don know how body be you.

The issue with the Nigerian economy be say unemployment yapa and as people no dey employed, e dey difficult to get savings. Even people wey try get side hussle, inflation no dey gree you plan well.

If to say most people for naija get employment and or get wetin dey bring dem steady income, then you can plan on it comfortably. Like more than 70 percentage of Nigerians na self employed people missed with those without employment including those wey dey do cooperate begging.

No financial social security wey dey work for naija or na individuals/politicians dey chop am. Otherwise, if them pay such money to you, you can easily lock it up with btc for at least two years and you go get return. I remember during the COVID-19 year in 2020, the US government give some families like $1,000 to support and some use am buy btc because them already get work wey money still dey comot from.