Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Our economy, a challenge to DCA plan.
by
Kelward
on 25/02/2025, 11:31:41 UTC
This is about Nigeria. Not DCA this time but NCA as you are specifically talking about our country and people that are receiving their wages or salary in naira.

NCA full meaning is naira cost average.

I de always think say DCA (dollar cost averaging) na acronym for a strategy where we periodically take money from our income to grow our investments irrespective of the country wey we come from. If I understand wetin you mean that is DCA na specifically for Americans alone because dem currency na dollar? I believe say na di first time wey I de hear of NCA (naira cost averaging) because na DCA I know wey dem de take reference di acronym for putting money aside for investment like Bitcoin, weda na naira or dollar.

For di matter wey OP start, our economy no de help many people wey de receive fixed naira salaries to comot money to buy and grow dem bitcoin investment. Dis na because di prices of goods and services de increase everyday while salaries still de static so di cost of living no de allow dem to put money aside to buy Bitcoin. Recently naira value don de appreciate small but e never get any impact for di standard of living of di average income earners inside di country. As di country be so make we no carry all our hopes put for di government to make di economy better, anything wey you fit to do legally to increase your income make you do am. E de important for people like us wey don understand di potentials of Bitcoin to de try to meet up for our NCA (DCA) strategy to increase our Bitcoin stash.