Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 4 users
Topic OP
Invest in bitcoin or save your money in the bank?
by
Joy- maker
on 26/02/2025, 02:30:45 UTC
⭐ Merited by PremiumcryptoHub (2) ,CryptopreneurBrainboss (1) ,Derekfunds (1) ,Mia Chloe (1)
Me dey always talk an any investment or anything wey no go double my money, count me out my hand no dey I no follow. Now wetting go double my money I dey do no matter the risk wey dey inside an.

Normally investing in bitcoin or saving your money for bank get there own advantages and disadvantages, which I go list them here, so that you go chose wisely if you go take the risk grow your money, or you go carry give bank make them use an grow thereself from that bitcoin wey you dey fear to put money.

Advantages of investing in bitcoin
1, bitcoin get high potential returns, if you put your in bitcoin, bitcoin dey deliver, because ehh don already prove ehh self to be store of value.
2, bitcoin dey operate for wetting oyibo call network wey dey discentralize, so if you put you money inside ehh dey secure, person no go fit touch an.
3, bitcoin get limited supply, them no dey supply bitcoin anyhow, now wetting dey make an maintain ehh value bit that.
4, many countries don adopt bitcoin as their means of payment and store of value, so if you put your money in bitcoin everywhere good.

Disadvantages
1, Bitcoin get high risk, the price dey fluctuate rapidly and unpredictable oh, so ehh fit give you high blood pressure if you mind no reach.
2, bitcoin price go fit drop within a short period of time, that is to say you go fit put like 100k ehh fit drop to 60k or 70k and ehh fit make your BP raise if your mind no reach.
3, for bitcoin now you go scure your money by yourself, so if you lost your wallet key seeds now buy buy be that oh and person fit still steal your bitcoin from your wallet if you no scure an well.

Saving your money for bank advantages
1, for bank you go fit go collect your money anytime wey you need an no wahala.
2, bank get low risk, if you put your money inside bank  high blood pressure no go see you catch.
3, if you save your money for bank you fit dey see small small money.
4, bank get people wey you go go catch if anything do you money.

Disadvantages
1, Bank get low return, nothing dey come out if you put your money for bank, for example if you put 100k for bank for 6 years now only 500 naira fit be your top up.
2, bank go charge you fees for services and maintenance, that small top up wey bank give you, bank go still collect an back, and bank go still collect from your money too, which you loose bank go gain from your money wey you put.
3, bank go dey use your money dey investment for that bitcoin wey you dey fear, dey get massive profits with your money.