Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: A friend scammed me of my PI
by
HajiBagi
on 27/02/2025, 15:54:23 UTC
Nigerians why can't we just be truthful to one another for once, writing this in pain. A scammer i consider as a friend scammed me of my 115 PI. His excuse was that he sent it to his own vendor to buy it but up till now the vendor has not sent the money and also the PI back. The main reason i sold was because i needed that money day before yesterday i couldn't wait again for the listing. Now i have nothing! What can i do to such a friend because am tired and we are not even in the same state?

You dey talk like say no be Nigeria you dey, So as your friend Don use your eyes see shege now waiting you want do because at this point him Don run you street already, them no dey trust anybody when it comes to money matter, Pi wey be say no be everybody do am and you get luck na him you go use your hand throw away Pi wey you get, although every body dey make mistake and anything wey God say it will happen to you must happen but you wey dey Nigeria with us still dey trust person.

At this moment this one Don be as example for you to not trust anybody when it comes to money matter, how many times you Don see friends dey betray person talkless of money matter, guy just forgive and forget about your Pi because nothing you fit do again, last last you go wan carry the matter go police station and na money you go spend at the end you go still lose the case.