Good morning my senior men for the furum. I greet una.
Considering the way bitcoin prize they fluctuate today em dey down, tomorrow em don high, many people including me I dey little bit lost I no fit know when to sell again.
you fit sell today at a current value of $100,279.70 and tomorrow the price skyrocket or you fit say you Wan leave am make the price high small before you know the price don fall.
So na watin need quick attention, make we talk am so one fit know when best to sell our investment. Thank you
Na waw for you oh bro, the Bitcoin wey you dey hold no be you get it abi na person get am? Bitcoin wey you hold you still dey need advice when you go sell it, if you know that as the price dey go down you no fit take it sell your thing, no be say I dey give you bad advice but na the way you ask question like say you no be better investor, as you dey plan buy Bitcoin waiting you put fit mind before buying it, I don't know about your own but anyone that understand Bitcoin no go talk like this.
Bitcoin na unpredicted investment that you can see the price dey fall and still dey rise any time, Bitcoin fall no mean say it will not rise again and thank God you too talk am say sometimes when you be try think about selling the price go still rise, so that shows you that Bitcoin go rise and when it rise E dey favor people, so this kind question wey you ask so just be like person wey never know anything about Bitcoin.