Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Merits 8 from 2 users
Topic OP
Negotiations for peace deal wit bandits go fit solve Nigeria insecurity palava?
by
Cossyblack
on 03/03/2025, 19:35:05 UTC
⭐ Merited by Zackz5000 (5) ,CryptopreneurBrainboss (3)
For about four months now, peace don return for Birnin Gwari local goment area of Kaduna state, northern Nigeria, afta one peace agreement di state goment reach wit di bandits wey bin dey terrorize di area. Di bandits bin agree to drop dia arms and stop dia reign of terror for in and around di state.

For dis matter, some security experts dey see am as beta development if dem put correct measures in place, e fit bring lasting peace for di northern region wey don dey battle insecurity for ova ten years.

Dr Yahuza wey be security expert and di managing director for Eagle Integrated Security and Logistics Company for Abuja, Nigeria capital believe say any measure wey dem fit take to avoid bloodshed suppose dey welcome since e fit bring peace, and di money wey dem dey use fight insurgents fit be use build infrastructure.
E tok say di bandits na Nigerians, which mean say dem fit go live dia lives for community.

"Dis bandits na Nigerians too, and some of dem fit get talent wey go fit benefit di country if negotiation happun between both sides. Because e go bring peace for di community."

"Di peace wey dey Birnin Gwari right now na proof say di peace tok fit produce beta result."
source

My countri people I say make I share this matter with una, una remember say kaduna state before na horror of bloodshed as bandits bin dey cause  alot of casala inside de state.Today kaduna state don become one of the most peace state for Naija based on the peace deal wey the new govt bring out, na make I say make share am with una like if other govt apply the same method,insecurity for Nigeria fit come to an end.

Abeg talk your own matter on how you take see am.