Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: PI NETWORK - Airdrop Phase
by
Stable090
on 07/03/2025, 19:13:15 UTC
The long awaited Pi Network is launching open network on 20/02/2025. Meanwhile Bybit predicted launching price to be around $100-$150 while some web3 experts are debating on the price saying; it's going to be around $550 - $800... Others; at least $80... Some crypto analysts are saying, pi network won't list above $3.5...
Everyone were just making speculations then, but how do we even expect Pi to be listed at $100, me I know say that one no Dey possible now, make we no Dey whine each other. In crypto, make we allow our expectations Dey low in any coin, if Dey wan list coin, me I no Dey put am for mind say dem go even list am at higher price, Wetin Dey kill most people be say Dey go don check social media, Dey go don see different speculations, people go Dey hype d coin, and people go think say na where road Dey be that, till dem list am, and d price wey dem list am no even near Wetin dem see on social media, Dey go come Dey vex.

What's your take on this?
Wetin I know be say, anybody wey mine am make him look sharp sell him thing ooo, no allow Wetin you Dey see on social media deceive you, and anybody wey wan buy, make him just calm down ooo, because dis coin go dump well. People wey Dey project high price for d coin in future just Dey whine themselves, make we keep our expectations low.

Were you mining Pi Network?
I don sabi about pi since, I even start am but I no carry am serious, and I no remember anything wey I use register that, I never had believe in pi coin, I no believe say dem go even list self, I think say people just Dey waste time, but e surprise me say dem later list am. Make I no lie you, e pain me say I no mine am ooo, if to say I carry am serious, something for commot for me now.