I have been studying the difference between Fiat and Bitcoin but I still get it twisted to understand what a Fiat mean, I would like the experienced members here to tell me the difference, I got to understand what a Bitcoin is all about but still confused on Fiat .
Thank you all
Op some kind thing no reach to use take creat thread, this na watin you fit just carry your hand type for Google make e for give you better answer. No be everything dem go carry enter forum, YouTube videos dey wey dey very educating, AI sef don full everywhere stay even our regular day to day WhatsApp sef wey we dey use don get inbuilt meta AI. And one thing about wattin you carry your own hand research na be say e dey sabi stay for your head unlike when person just talk wattin e sabi or feel say dey right. Bitcoin and fiat na two different type of currency if you do your research you go understand better. So take am like assignment make you improve your knowledge.