Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Is education really important anymore for the Nigerians?
by
Mpamaegbu
on 08/03/2025, 15:58:41 UTC
That he wish those times he was wasting time working so hard to trained them in school he would have rather paid for them to learn an and work.
A lot of awa parents had dat same mindset of sey if we go school na im be sey life don betta for dem and na why dem nor reason hand work or skills acquisition. Now, dem don know betta. I also believe sey those of us wey be parents here too go don learn wan or two from wetin dey sup with Naija and work and begin make plans how we want our children dem to be in future.

I know sey graduates full dis forum but most us nor dey work with awa certificate. Na dis industry dey grease and survive us. E com be like sey na skill wey we acquire. Wetin make awa tertiary institutions nor too make sense be sey dem nor dey teach financial literacy. Na just to read, cram and pour we dey do. The real world needs financial literacy if persin wan survive am.

As for whether education make sense? Yes, e make sense too much. If not for anything, at least to be able to read and write awa names and sabi how to calculate awa money.