So lately I Dey see many post about the comparison if gambling and trading, our problem be say we nor wan learn we just wan earn , because we Dey see traders life style via social media , so we come sep picture trading as means to get rich not knowing “ is the hardest way to make easy money “.
I Dey talk base on experience when I start trading I nor bother to go deep in the learning aspect I just go for the basic knowledge, with the mindset of if the price come down I go buy if e go up I go sell after everything I end up regretting my actions after countless losses if nah say I calm down learn first I for nor go through those kind losses .
We just wan go the destination without knowing or experiencing the journey, all successful traders went through this stage you are in now before getting where dem Dey so , Dey pass through the journey .
So drop some mistakes wey you know shey people Dey make for trading well well if you get any .