Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 6 from 4 users
[GUIDE] Overview of the trust flags
by
Hatchy
on 09/03/2025, 21:39:29 UTC
⭐ Merited by Upgrade00 (3) ,GazetaBitcoin (1) ,Porfirii (1) ,Charles-Tim (1)
Original Topic:[GUIDE] Overview of the trust flags
Author: Upgrade00


I make up my mind to do small research for inside d new trust system, so e go dey easy for new people dem to take understand d system for inside one thread.

all d account wey I use for here, na just for example, me no support or oppose any of d accusation.


Watin be trust flags?

dem introduce trust flag, so e go help break down d trust system.
Introduction thread: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5153344.0
To take warn members say some people fit be scam and fit be say dem don break contract wey dem make or write.
d old trust system go help calculate d trust history of person. e go give general view of how much we fit take trust forum people. we fit use d trust system for negative, positive or neutral  feedback. Trust flag na only for negative feedback. u fit delete trust, but u no fit delete flag once e don dey active.

Trust flag go need at least three or more people wey dey support am instead of to oppose am. na only support wey dey come from Ur trust group go count, for guests, dem go use d default trust.

Types of flags wey dey
- flag wey dey warn newbie : dem dey give dis one if evidence dey wey talk say one user no fit dey trusted i.e, d matter no actually dey connected to u.

u go fit see am untop d person topic and e only dey visible to guests wey be newbie and members wey don log in for less than 7days.
while other people dem go only see '#' beside d person trust score.
make we see dis user, The-One-Above-All.
d account get newbie warning flag for e profile.



-: flag if you break Contract:dem dey give dis one base on activity wey dey directly connected to u. for example, dis user NLNico don put flag for d user SafeDice and e come get many support pass opposition (>3). d flag dey show for d user( person wey scam) trust summary and also for e topic dem( members go fit see am).

u go fit still see am through d feedback wey NLNico send.

users wey log out go still get warning
users wey log out go see d warning for trust enabled section, if more DT members come give d person wey start d topic negative trust pass positive trust

•flag wey dey active go show yellow color.
•contract violation flag wey get red trust go show red. dis one go on d: "Warning: Trade with extreme caution" for d user trust score.
• flag wey dey warn about newbie dey also show as yellow and red colors.
• person go fit create both newbie warning flag and flag wey break contract.
•u no fit create flag with thread wey dey self moderated as link. e also dey adviced say make u no use post of d person wey scam, instead archive d evidence, create new post and link all d evidence for there.


Who go fit start flag?

anybody go fit start flag wey dey warn about newbie, e go need more support than opposition for am to show.
 
anybody wey another user scam, go fit still start flag wey break contract. u go only fit view flag wey people for Ur trust network create. e go need at least three or more supporters pass people wey dey oppose, for am to dey active.
u fit create trust flags through link wey dey user profile.
but u go need to dey sure of Ur evidence before u create or support flag;
u dey confirm clear matter, when u create or support scam flag. if person still support flag wey e know say e no correct, den dat one dey clear say na abuse, I go make sure to remove those kind people from DT asap. we go also commot people wey dey wrong (even if say dem no know).


How long d flag go take show once e dey active?
because of forgiveness/redemption, scam flag go expire 3years after d matter, if d contract dey casual/implied, and 10 years after d matter if dem write d contract. administrator go fit change d expiration time
for some cases.

limits dey for flag wey user create:
na dis limit na e dey:
 - u go only fit give one flag for each type to person inside 180days. so u no go fit give person plenty contract violation flag wey dem write inside 180days. for example.
 - Globally, per year u go only fit create 1 flag per d activity points wey u get but at least 1/year.


d flag system cancel all d old negative trust?
negative trust from d pre-flag system no dey convert to trust flags but
- if d number of pre-flag-system negative trust ratings many pass d number of all positive trust ratings, e go show one warning barner for guest and newbies wey get small login time.

abeg drop your suggestions, additions and any corrections wey dey.


Useful links -



na AOBT na run dis Translation by Dem self