Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Tinubu orders deduction of salaries of civil servants?
by
Princess Leah
on 11/03/2025, 00:24:50 UTC
If it was as a result of excess payment then i have no issue with the order. I was surprised when i saw the headline so i have to make my own research to find out that the information is not on any well known reporters website like Vanguard and the rest. How sure is this since its Saharareporters sharing the information with Facebook and YouTube. Dont get me all wrong here, i am just saying that the information has to be solid so that we dont go around spreading the wrong information. But if it is true then its no big deal. He paid them more so he has to balance it all up.
now you dey talk this kind talk for you mouth? I no believe say person like you go talk this kind talk no wahala now because say you no be civil servant shall that why you are talking like this, and beside how much Tinubu even pay government workers self last year, wey go make an come talk this kind rubbish, Abi shame no dey catch an, that thing wey federal government dey pay civil servant now salary, can that salary run a home, well I no blame an shall now people wey vote an put for there I blame, beside Nigeria don expire, the country is already dying so make I no even waste my time dey talk about Nigeria.

Nigeria citizens should better wake up because this thing called government of Nigeria no get any better plan for their citizens, because Nigeria now business ground wey politician dey use enrich thereselves, see how much wey them dey pay senators for doing nothing, them no dey work anything, now civil servants wey dey work them dey pay them pinut, habi where there conscience dey,

Hmmm, our country people this matter tie wrapper oh, lemme be sincere ehh, wetin this Tinubu regime dey do no dey good at all, the kind shege them dey show people no be small, maybe some people fit dey privileged to dey benefit from getting the right informations from the Internet, we fit get better hedge but make we try call spade spade, try dey consider people dey earn solely from the government cause people are suffering.

 I no dey try dey emotional about this discussion but the peanut wey most of our mama and papa dey earn from this corrupt government no worth to deduct their salaries over cooked up story by government to defraud people, okay why them no go deduct the money from account of government officials wey make the mistake why from the poor masses, make we try dey call spade spade joor.