Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: MarryWithBTC: How I Wan Pay My Bride Price with Bitcoin.
by
Mpamaegbu
on 11/03/2025, 14:09:41 UTC
But wait o, Bitcoin no dey lose value like naira. If I use BTC pay my bride price today, e go still dey appreciate as time dey go. Who know? E fit be like say I use small money buy whole kingdom for future!  Grin
Who tell you sey Bitcoin nor dey lose value? Check d price in 2022 and now you go realize sey nor be d same thing. Just like Naira, e dey lose too, d only difference be sey Bitcoin get dat nature to rise over time after e dump. Dat wan na sure.


Anyway sha OP, d thing wey you carry for mind to do nor be bad thing but na bad timing and unnecessary exposure and gbege for yourself. You sabi how insecurity nor be anybodi friend for we kontry now. Doing dat go mean sey you just wan expose yourself to risk where nobodi send you work oh. We dey preach privacy and anonymity for dis industry. Nor go use youthful exuberance take expose and cause yourself regrets. If boys hand touch you, you go realize how needless d points wey you wan prove dey.