Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: MarryWithBTC: How I Wan Pay My Bride Price with Bitcoin.
by
Stepstowealth
on 11/03/2025, 17:06:09 UTC
I dey go by di name "MarryWithBTC," and no be lie, di name get weight! Dis year, by Baba God grace, I wan do something wey fit make me enter Bitcoin history—I wan pay my bride price with Bitcoin!
Maybe na this our generation go fit dey accept BTC for our pikin wey dem come marry based on say we get the knowledge from small cun enter old age, but if na this our generation of parents, I advise say make you follow the one wey dem know, nor go try do anything foreign because normally na traditional rites and nor be only one person dey chop pikin bride price because nor be only one person train pikin as our people dey normally talk. If you carry BTC give them, how dem wan take share am among the papa's dem?