Hello my people!
The reason for this thread is that I want to link up to real women in this forum that are within Port Harcourt. I know this is a privacy forum, but I think this initiative will enable my dream of creating a platform to promote Nigerian women in Crypto. So, if there is any woman here who doesn't mind, we can meet in Ph and start from somewhere. Thanks to you all.
Dem say what men can do women can do better. I like that your spirit of adopting bitcoin even you as a woman because for our country here for Nigeria, the fear and doubts way women get for technology especially when e get to do with money dey very high way make dem dey very hard to invest for anything crypto currency.
But see my sister, security measures no be wetin person supposed tolerate with so I think this linkup you dey talk about fit dey risky oh because you non know everybody mind. So I suggest make the interested women here indicate make the linkup be online like telegram instead of face to face meeting.
That adage no really they work for everything come to even think for this our generation wey every woman prayer na to marry successful man but they no they ever pray say make them dey successful. The adage suppose be say what a man can do some women can do it better. This our sister wey don showface her face for the LB done try well well. I like to they see things like this.
You talk well o for the link up matter. Make them just do am for telegram