Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: I trust BTC more than I trust my bank
by
nelson4lov
on 15/03/2025, 22:08:14 UTC

Be calming down about the high level of trust wey you get for this digital currency, BTC dey legit no be lie but e never reach you to carry almost all your income put for Bitcoin investment because anything fit happen, what if you come wake up one day come see say everything don disappear without a trace? Like you enter the market now and everything dey void like crypto currency never happened, how you go take recover all your income wey you don put already. Try dey think more of the "what if" because the founder of this digital currency fit don put auto shutdown mode wey we no know, Hahahaha. Personally I trust BTC but e no mean say I no trust bank too. I trust them both.

The same way cash in your bank fit disappear even though you no authorize am? Banks sef fit close down without paying customers their balance. At least with Bitcoin, everything is fully transparent.

For instance, E just dey as HyperLiquid (a Perp DEX) recently dey face challenges with liquidations and margin. Now, everyone is seeing everything that the attacker is doing because everything dey onchain. Not on CEX that everything is hidden and you no know if the CEX (or bank in this case) is solvent. E dey like schrodinger's cat. You also have to "trust" your bank too. If you're going to trust anything why not a transparent blockchain technology where everything is provable?