Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: MarryWithBTC: How I Wan Pay My Bride Price with Bitcoin.
by
MarryWithBTC
on 16/03/2025, 15:09:41 UTC
Okay... I hope the bride price wey you dey talk be all the property or material , food and drinks including money wey you go spend during the marriage rites/rituals and ceremonies for the marriage? And you go either transfer the btc to the family make them take go buy the things.


Abeg, make una wish me luck as I start dis journey. If you get advice, joke, or anything wey fit help, abeg drop am here. Make we make dis thing fun and engaging!

Who know? Maybe after my story, some of una go wan marry with Bitcoin too!


I don dey already wish you luck for your adventure for your drive to inscribe your name for the annals of bitcoin history like Laszlo Hanyecz, the guy wey buy two pizza with 10,000 btc.

So where I go take contribute in be say about media coverage. I don't know whether Laszlo Hanyecz case na intentional act or not but media carry am and today everybody accept the story without any other person coming out to claim the story or history. Therefore, I hope you go get serious media coverage wey go capture the wallet address, output and input, how many fraction was sent out (because I know say no be one btc lie lie).

So make sure say you get media coverage if possible you get a blogger or newspaper house or TV station so that them go dey run am as news for you until the thing circulate because oyibo fit kill the story as dem dey like make only dem get history.
Thank you brother for your concern and suggestions. Normal normal, video coverage go dey for marriage ceremony. But to video the transaction process, that one no dey necessary. I only need to post the address and TXID. Oyibo has there way of killing our history, but this thread we dey used discuss so go be reference and when i make the transaction, I go create thread for this forum with the tx Id and then post the same for my social media handle and that is the only publicity I owe it. I no go go radio house or newspaper  to prove say I marrywithBTC