Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No such thing as a Perfect Strategy in Trading
by
sotelorene
on 17/03/2025, 12:48:13 UTC
So if you really want to be a trader, then set long-term goals, you have to do a lot of research and learn, collect various important information from different places, and keep them in your mind. It is possible to earn money from trading, but it is not an easy path, you have to work hard, be disciplined, be patient, and keep the tendency to learn new things at every moment. Then success will definitely come at some point.
Make sure say as you dey learn new things, been patient, and all of that, be sure to get money add am. It's bad knowing strategies, technical and fundamental analysis, using advanced tools and still no get money to use trade, na wetin person no wan talk about. Everybody wan talk about making profits, making money, doing great but no body is talking about your deposit funds, it's very essential.

E go bad if you sabi all these analysis and you know get money to dey use execute am, and na why all these telegram group dey ask for registration fee for signal, these people may claim to be an expert but them no get shishi to even fund their trading account sef.
See everything wey you talk here na true because many people go talk about all the strategies and how them wan take make profits from trading, but them no dey talk about how them wan take fund their account because sometimes e go dey bad say we talk everything how person go take make profits but no even any plan of execution, like this e dey very bad and when talking about things and also them get funds to carry trade am e dey sweet wella pass when people talk finished nothing to carry support am up. Again, all those criminal wey dey telegram dey request for money no even get anything to carry start their trading journey na why them dey serious dey worry people to pay some fees to take support themselves.
This na wetin newbies never ready to listen and learn, they are still carried away by the illusions that once them pay for signals, them don become rich. Wetin dey truthful be say, person no go teach you wetin dey give them money, them go silently dey do their trading dey go not minding the fee from anybody. Na person wey no get money, dey arrange group to dey use deceive en members by dropping signals or even teach them trading.

Na true you dey actually talk like this oo some person dey think say na just signal be the main thing but the truth be say no be every time signal they work or no be everytime signal dey always dey correct and aside signal I believe say e get some kind small small thing person suppose do again. This point wey you make now say some traders they use people dey generate funds to use trade na true oo, e get one of my course mate that time wey don learn trading but after en learn finish en no come get money to use trade, as en look no way na so en arrange for tutorials ooo they use the money they use trade and funny enough people wey en dey teach no dey even show proof say they Dem actually learn trading. But some people get genuine intention sha, they go teach you everything way you suppose know though not everything because there are things you will need to learn by yourself in the process of learning from someone.