Di rate way many people especially di younger ones de take rush enter crypto trading based on wetin dem de hear de very alarming. Unto say dem de find online jobs or side hustles, dem go get misleading information say crypto trading na di place to de make plenty money everyday. When dem rush enter and lose all dem funds, na dat time dem eyes go clear say no be get rich quick scheme and say trading no be for everybody.
I no know if Una do observe all these people way the come radio stations the talk about trading seminars and how people wey dey interested make them text a code to their phone number then them go reserve a seat for them. As in, this people go the talk for radio about how easy trading is, and how you don't have to fear or stress much to be a successful trader in no time.
Seriously, whenever I tune to these stations and hear this people talk I feel sad for the innocent people wey go believe their talks. But go later on realize am when them go done lose enough money wey dem no expect. Abeg make we dey try preach to people about the risks involved in trading more than we talk about the profits we make.