Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Trading no be get rich quick scheme
by
Stable090
on 17/03/2025, 22:04:38 UTC
Di rate way many people especially di younger ones de take rush enter crypto trading based on wetin dem de hear de very alarming. Unto say dem de find online jobs or side hustles, dem go get misleading information say crypto trading na di place to de make plenty money everyday. When dem rush enter and lose all dem funds, na dat time dem eyes go clear say no be get rich quick scheme and say trading no be for everybody.
Na things wey people Dey see online Dey make dem rush come join crypto now, most of the testimonies wey people Dey put for social media na fake, some of dem wey Dey YouTube just Dey look for subscribers, and d ones wey Dey TikTok Dey look for likes, but people wey no sabi Wetin Dey sup go think say all those things Dey real, and na so people Dey make money for crypto space.

Most of all those people wey Dey get signal groups for telegram, and WhatsApp, dem Dey among people wey Dey make things worst, dem sabi brainwash person, dem go talk everything wey go just make you get confidence in them, so that you go pay dem just to join their group, and if you don pay finish, dem no Dey provide any better thing, Dey just wan chop money.

Plenty people wey Dey join crypto now go don lose money first before dem start to Dey understand Wetin e Dey all about, if some don lose money, dem go give up, and some go take their time learn about am.